Glosa bi ril langwej na langwej wey dem form to fit helep pipo wey kom from difren neshon to komuniket. Glosa get plenti karata an dem bi:
- E get method an way wey dem tek dey spik-am, an na di way pesin tek kol di word komot from im mouth na so di pesin go tek rait am.
- Dey arrenj di group of word for Glosa langwej in a way wey de simpu an na akordin to how e tek mek sens wen pesin tok-am.
- Glosa langwej na langwej wey pesin nid to kul down an tink am wel bifor pesin go fit ondastand am; di langwej no get words wey wey dey show weyda somtin na man or wuman, weyda somtin dey hapun now or e go hapun leta, an weyda pesin wey dey tok de in gud mood abi bad mood.
- One singu word fit min meni tins for Glosa langwej. Di Koko bi sey: Glosa na langwej wey de neutral an wey de intanashonal bikos di orijin of di langwej kom from Latin an Greek, sins Latin an Greek na di langwej wey intanashonal sayentis dey yuz komuniket.